Music: Ijale Godwin
Me no wan kpai inside depression
Na why I the grind the find solution
Many the try take my position
But I no wan be that sabinus investor
Give me the strength I no wan give up
Íķòņ țór juri mèlò múfe sò
Show me the way make I no go fall
From my lyrics you go tell this no be love song
Who de wash no de pray for rain
Omo my eyes don dirty baba see my pain
I don de work I no see the gain
So many guys for the street them go fit relate
I still de work and I still de pray
When my time cef go come
Baba I still de wait
Show your face make I know my faith
Cause if I wan give myself dem go still the hate
My story
My story
E no easy but I give God the glory
I go easy and I light up my kpoli
I don de sing but nobody notice
From glory to glory
E no go bad if I give that kind story
In a convoy make I ball with my homies
When I fall out make everybody notice
2021 me I run from home
How I take survive Omor nobody knows
Papa no Dey o
Mama no get o
Sapa cef de play me like say I be lotto
And then nobody gives a ****
Them post we’re outside
Me I Dey door
As money no Dey how I go take comot
But one day I go Jaye till thy kingdom come
Shoutout to YB my gee wagwan
I remember the days we survived on last card
We no be seyi
But Omor different pattern
No money for uber Omor we fly okada
I de drop verse but them no the listen
But I no go stop
Omor me I no go fit quite
And as Igede boy wer de rep lasgidi
I know say one day I go show up for their tv
And I go sing bye bye to all the pains and tears
Mummy please wipe your tears
I go win I beat my chest
And for a long time I don de face my fears
I can’t run away from them
If them count people make them count me first
Baba no forget
My story
My story
E no easy but I give God the glory
I go easy and I light up my kpoli
I don de sing but nobody notice
From glory to glory
E no go bad if I give that kind story
In a convoy make I ball with my homies
When I fall out make everybody notice