Music: TC BEATZ
Hmmm oh oh oh thank You Lord
Tc on the beatz pon the rhythm
Ye ye ahh
Ooh ooh yeah
From the gutter to the glory na
You carry me
All the nights wey I dey pray
Baba no sleep
Street no funny but Your blessing
Still dey follow me
Now the light wey You put
For my head dey blind enemies
I remember days when the pocket dry
Zero balance still I hold am tight
Papa God talk say my son
Relax I dey by your side
Now everywhere soft
Like Sunday night
Grace dey carry you
If no be God I for don kpai
If no be God who go wipe my eye
If no be God blessings for no fly
Na Him lift me up
When the world say bye
If no be God from
Nothing to something
If no be God my story
No go sweet like this
If no be God na Him turn
My mourning into dancing
If no be God I no go reach
Where I dey stand today
Dem no know wetin I see for road
Dem just dey look the shine wey dey glow
Baba fight my battles low key e no loud
Now victory anthem don full the crowd
Blessings fall like confetti
Doors open wide e shock many
Those wey laugh me
Yesterday wan relate
But I no get wahala
My heart no dey hate
Tc on the beatz again
If no be God I for don kpai
If no be God who go wipe my eye
If no be God blessings for no fly
Na Him lift me up
When the world say bye
If no be God
From nothing to something
If no be God my story
No go sweet like this
If no be God na Him turn
My mourning into dancing
If no be God I no go reach
Where I dey stand today
He lifted me
He carried me
When I fall You lift me
When I cry You hear me
When I weak You carry
Oluwa Your love dey fear me
Tc on the beatz taking it higher
If no be God I no go stand
From nothing to something na Him hold my hand