Lyrics: Abiodun Odukoya
Music: Abiodun Odukoya/Gert Kapo
LYRICS
Abiodun – Alarm Don Blow
Ariwo, ariwo l’adugbo mi
Ariwo, ariwo n’igboro mi
Alarm e don blow-o!
Alarm e don blow-o!
You say you dey seek for your right
while zombie dey look for flesh to bite
Alarm e don blow-o!
Alarm e don blow-o!
Get up and demonstrate for your right
if not yawa go happen tonight
If you be human then why you you dey fight like animal
If you be officer why you dey behave like criminal
If you be Christian why you dey worship satan
If you be muslim how come boko na haram
I be like say zombie don wake
dondi dey yand mugu dey shake
fire dey burn inside house
everything don turn upside down
vulture dey chop, eagle dey shit
tortoise dey run and lion creep
teacher dey lie, me i dey spit
fire kata
Alarm e don blow-o!
Alarm e don blow-o!
You say you dey seek for your right
while zombie dey look for flesh to bite
Alarm e don blow-o!
Alarm e don blow-o!
Get up and demonstrate for your right
if not yawa go happen tonight
Ariwo, ariwo l’adugbo mi
Ariwo, ariwo n’igboro mi
Corrupted minded evil leaders dem tell we say dem sabi
dem only aim is to chop the money and gain heavy salary
people rejected economy infected – still dem say dem sabi
no one protected , virus detected - still dem say dem sabi
dem want to step on our human rights
but the echo na justice dem no fit hide
Alarm e don blow-o!
Alarm e don blow-o!
You say you dey seek for your right
while zombie dey look for flesh to bite
Alarm e don blow-o!
Alarm e don blow-o!
Alarm e don blow-o!
Alarm e don blow-o!