Lyrics: Nerat Favour Chuwang/Nicholas Ifeanyi Umebirim/Kyellu Tsamdu
Music: Nerat Favour Chuwang
Oh yeah yeah
Nooooo
S.O.N on this yeah yeah
Many many things wey for make me craze but I get God grace
I dey thank God oh
Even the challenges I face
no fit stop me to give God praise
I dey thank God
Money no dey for pocket
Money no dey for budget
I dey thank God oh
When Water no dey for bucket
Na God be my plug for socket oh
Me I dey thank God when I dey smile
And when everything soft for my side
Even when I dey cry, Before I dey ask God why
I dey thank God oh
I dey thank God oh
Thank God oh
I dey thank God oh
Person wey sleep for night come wake
Suppose know say na Papa God grace
I dey thank God oh
I dey thank God oh
As I dey count count my blessings one by one
I dey see wetin God don do
All the times wey Him don come through, come through for me
And Without a doubt
The hand of God Dey for my Life
I dey win my battles I no need fight
Cause Olugbeja me e no fey waste time e be like shoot on sight oh
Me I dey thank God when I dey smile
And when everything soft for my side
Even when I dey cry, Before I dey ask God why
I dey thank God oh
I dey thank God oh
Thank God oh
I dey thank God oh
Person wey sleep for night come wake
Suppose know say na Papa God grace
I dey thank God oh
Me I dey thank God oh
Thank God oh
I dey thank God oh
Thank God oh
I dey thank God oh
Person wey sleep for night come wake
Suppose know say na Papa God grace yea
Na the grace of Lord wey dey keep me so
I dey thank God oh
So I dey thank God wey dey bless me
Thank God wey dey keep me
Thank God everyday
I go deyย thankย Godย oh