My View

Lyrics: Dele James Kola Music: Dele James Kola Woah yeah Woah woah So me say! It upgrade sing song yeah Tell dem make dem know
Too many times I’m scared To say many things i wan clear up my chest But i dey chicken out I no dey fit talk my mind I no fit spit it out Na i go dey look like cinema Omo things dey sup Dem dey look me like ju’ man (Aboy weda you)
Na money matter Because of conscience for my heart Money no dey my hand Me i was raise with the fear of God And i dey pray every six o’clock That’s why i no fit use your plug Forgive me if i no chop your sauce Wetin i no get no dey hungry me No vex no turn me to your enemy For your eyes i know i no wise But the fear of God na the beginning of wisdom
I say me i no dey judge Wetin people wan see na result As far as you dey see em clear Family and friends aswear dem go rejoice oh say me i no dey judge Wetin people wan see na result oh As far as you dey see em clear Family and friends dem go dem go rejoice oh
Too many times I’m scared To say many things i wan clear up my chest But i dey chicken out I no dey fit talk my mind I no fit spit it out
Where is our morals? Na young boys we get no be fathers You no fit carry anyhow money come back home (Back in the day) Aswear dem go scorned you Interrogate you You go explain too How you take see money way huge?
If you commit abomination (Dem go disgrace you) Aswear dem go disown you too (It’s is shameful) But now we celebrate crime Justify evil at the day time You fit break the law if money dey your hand You fit come evil walk away to be to bribe?
Me i was raise with the fear of God And i dey pray every six o’clock That’s why i no fit use your plug Forgive me if i no chop your sauce Wetin i no get no dey hungry me No vex no turn me to your enemy For your eyes i know i no wise But the fear of God na the beginning of wisdom
I say me i no dey judge Wetin people wan see na result As far as you dey see em clear Family and friends aswear dem go rejoice oh say me i no dey judge Wetin people wan see na result oh As far as you dey see em clear Family and friends dem go dem go rejoice oh