Chidinma

Lyrics: Ogunade Gbolahan Mathias Music: Ogunade Gbolahan Mathias Oh no no no Yeah yeah yeah yeah (uh uh) She say her name na Chidinma oh My African queen, my sugar, my butter
From the moment I see your face oh (see your face oh) E be like say I don dey craze oh (I don dey craze oh) Your body fine, your skin dey glow oh (dey glow oh) Na only you fit make me slow oh (make me slow oh)
You be melody wey dey sweet my soul Your love dey make me lose control Anytime you smile, I dey feel alright Girl, your body be my paradise
And I no fit lie (no fit lie) Na you dey burst my mind (burst my mind) Baby, you too fine (you too fine) I fit do anyhow for your love tonight
Chidinma, my lover (oh Chidinma) Girl, I go fight for your matter (I go fight for your matter) Na you dey sweet me like zobo (zobo) Na you dey make my heart go kpo kpo kpo Chidinma, my sugar (my sugar) I go love you forever (forever) If dem try come between, I swear Na thunder go fire the wahala
You dey enter my eye like movie scene (movie scene) You be my gist, my gist for the midnight thing (thing) When you call my phone, I dey pick within one ring Na you I dey see for my daydream
Make we run away, baby make we japa Na your love I want, I no need another If na play, I no dey play with you You be blessing wey I pray for too
And I no fit lie (no fit lie) Na you dey burst my mind (burst my mind) Baby, you too fine (you too fine) I fit do anyhow for your love tonight
Chidinma, my lover (oh Chidinma) Girl, I go fight for your matter (I go fight for your matter) Na you dey sweet me like zobo (zobo) Na you dey make my heart go kpo kpo kpo Chidinma, my sugar (my sugar) I go love you forever (forever) If dem try come between, I swear Na thunder go fire the wahala
Omo you too dey ginger me Your love dey scatter me Girl, your body therapy Make I dey with you permanently Chidinma baby, you be my destiny No be play, I talk am sincerely
Yeah yeah yeah (Chidinma oh) Oh my Chidinma (my Chidinma oh) Baby no go leave me oh (never leave me oh) Na your love I dey see oh (see oh)