Ijoba Cruise

Lyrics: Judice Music: Judice Make them clear road make the king for sitdown Abeg.
I don tire to sit down they chop mummy thank you Na why I enter market buy lappy come they hustle Please don’t get me wrong, no be the only way that But since I grad na so so giving CV non is coming back. Why e be same people wey build hospital for here Comon fever them go travel leave hospital for here U Dey smile, hope u get point no Na we get national cake, but na just few Dey chop na Daylight robbery Dey occur daily for we high way By our men uniform, and our rifle, obviously dem don high way So So so so Audio announcement Palliative matter just die, with no alignment
But I know say deep down we Dey vex We Dey pay you with our money, Na still we you Dey stress But I know say deep down we Dey vex We Dey pay you with our money, Na still we you Dey stress
Most Times, I don’t feel like Living Here But I no fit japa cause na me roots be here Ijoba use us catch Cruise they play truth or dare No worry e go better question na when Most Times, I don’t feel like Living Here But I no fit japa cause na me roots be here Ijoba use us catch Cruise they play truth or dare No worry e go better question na when
But popsi say na wetin dem don Dey talk Since him small, but them no Dey work d work Them be like mad men wey talk inside market U go know say too much talk no Dey full basket Na y that year me bros for creek eye Dey red Omo no near those men all of them na dead dead Na them teach us say if you fear you go die Who no fear go still die, why not die ur die 2 secs all we smalla mind scatter reach Nobody be small pikin nigga mind your speech Dem talk say all of us for here no normal No be lie we country sef no normal. Our president talk say we be lazy youth So the crime rate increase, we Dey find work to do Most times I wonder I wonder why Why dem Dey call am high school but our brain no Dey high

WhyteMagik