Lyrics: Chukwudike Emmanuel Amadi
Music: Chukwudike Emmanuel Amadi
Eheh...
My handsome Alex, my baby oh
You be light wey dey shine for my soul
Every step wey you take, na blessing
I go love you pass my own essence
Handsome Alex, my baby boy
Glowing face with perfect smile
More of you na perfect joy
My baby, my baby
My handsome Odogwu
Nwokeocha ji aku
You be king wey dem no fit subdue
Alex, you be gift wey God don dash me
Your future bright like Lagos traffic
Na you dey make my heart dey dance
I dey thank God say you get this chance
Nwokeoma, my pride, my son
Anywhere you go, you go carry crown
Dem go see you, dem go hail you true
Na this Alex dey rule the town!
Handsome Alex, my baby boy
Glowing face with perfect smile
More of you na perfect joy
My baby, my baby
My handsome Odogwu
Nwokeocha ji aku
You be king wey dem no fit subdue
Alex, my star, my champion oh
I dey pray make your blessings overflow
Na your mama dey sing, with love dey glow
For you my son, my handsome hero
Alex, my star, my champion oh
I dey pray make your blessings overflow
Na your mama dey sing, with love dey glow
For you my son, my handsome hero.