Lyrics: Marvelous Junior/Chiagozie Anatune Destiny
Music: Marvelous Junior/Chiagozie Anatune Destiny
(Spreddem)
Normally if I start dem go say
Me I don come
Started from a place where you know
There’s no work
Eledumare just decide to show me love
I know am a sinner man
But he still Dey hear my words
You say you be my bro
For my back you suck my blood
(Suck my blood)
Blessings on blessings
Steadily dey lift me up
Back inna those days
When there is no food to chop
I dey live my life I know say i no go
Shalaye
(Omoh)
The matter long i no fit shalaye
You hating on the blessings
Wey Dey come my way
Me and my bro
We just Dey celebrate
We Dey elevate oh
Shalaye
(Omoh)
The matter long i no fit shalaye
You hating on the blessings
Wey Dey come my way
Me and my bro
We just Dey celebrate
We Dey elevate oh
Who no know go know say this kind of journey wey I take it is a risk
Akachukwu nor ya tell me y I go de miss
I no fit to resist
This blessings I de see
Every day by day
Na to de go down on my knees
As I hustle for money
I Dey hustle for family
All of my haters go think say
I don de call osimiri
Brother me I no de sleep
Until I make all the money
Drive the rover thank Jehovah
Me I go de shalaye
If money come I go de trabaye
10 milli we spending on a Saturday
Call my pple call azubike
Everyday na holiday
Me i no go Shalaye
(Omoh)
The matter long i no fit shalaye
You hating on the blessings
Wey Dey come my way
Me and my bro
We just Dey celebrate
We Dey elevate oh
Mama say look in the sky
What you see is paradise
That why me dey run my race
Me I no wan look dem side
Evil people for my back
They wan try to off my light
But no matter what dem do
See I go surely shine oh oh
Brother man oh
This life one
When the money Dey
Chop am before anything go sup
Tomorrow go better
Na your story dem go talk
I no say things hard
Very soon e go soft on God
Shalaye
(Omoh)
The matter long i no fit shalaye
You hating on the blessings
Wey Dey come my way
Me and my bro
We just Dey celebrate
We Dey elevate oh
Shalaye
(Omoh)
The matter long i no fit shalaye
You hating on the blessings
Wey Dey come my way
Me and my bro
We just Dey celebrate
We Dey elevate
Daily on the road
Daily on the road
Aka chukwu no for my matter boy you know
Me I don de go
Obodo yibo
Everywhere I go the people know
The boy bukwa anointing
Spending cash like is nothing
Original no parody
I no fit give up for nothing
Aya ya ya
Ebube monso Biko ayi no Nnirugi taa
Biko bia yem ego
Bia yem ego
(Spreddem)