My Shayla (Acoustic)

Lyrics: Arinse Somtochukwu Promise Music: Arinse Somtochukwu Promise Oh my Shayla pause gimme something way go sweet like vanilla Me I day loose comfort finding Wetin e go cool my medulla She day ball me Sam Okparaji Anytime she enter muwa edelu ji Our love no go end na till infinity Make me weak in the knee na disability
Make them clear road Me I fit waka on my ten toes The way she boogie down the way she bend low My baby gat me feeling like a psycho
Shay na kudi way you want o I get am many omo no be mouth o 10 meter e go do you for the night o Money na water omo no be childs o
Nwanyi oma where you day day I don day find you tay tay Iga rapu mu nawazi bebe
I day sing for you Omah lay lay Play me like Jay Jay Omo no go do me shege No go do me shege…..
Oh Jolie…. All the shima way day text me Adekunle una no fit to Simi Na my Shayla go born all my pikin (Na my shayla go born all my pikin)
No ves say you high on my gbedu If my kele ginger i fire like bazuu Ohema go make me to jump inside lagoon (E go make me to jump inside lagoon)
Make i day vibe on the beat Machala I don see person way cut my sandals Person way match my krays Make me gbess Omo perosn way light my gbana
Badman knack the beat lagbaja You no fit understand our pattern We scatter the place We no look uche face Anywhere way we burst in na shutdown
Nwanyi oma where you day day I don day find you tay tay Iga rapu mu nawazi bebe
I day sing for you Omah lay lay Play me like Jay Jay Omo no go do me shege No go do me shege…..Manya o