SeniorMadMan

Lyrics: Holdgod Homtapwa Simon Music: Holdgod Homtapwa Simon [Prod. Tag] Blackboy
[Intro] Oh nuh nuh nah na na BadManSpillz cheei BadManSpillz sheesh
[Pre-Chorus] Dem been dey give me problem But my God passy dia problem Dem been no want dey sendi me But where I come from Nobody send anybody Make you dey for your government For every corner wey you dey Na men dey govern am I be king for my area
[Hook] Na who first craze, na em be Seniormadman (Senior) (Oh nuh nuh nah) Na who first craze na em be Seniormadman (Oh nuh nuh nah)
[Verse 1] (See) Dem no dey put phone for back pocket go ATM You go hear word Men go run you street Your eye oh, you go see blood Dem no dey telli blind man say rain dey fall for outside I say na wahala For the place wey dem come from (uh nuh no) And if you no sabi do this one Omo na long talk (uh nuh no) I say I never never never never never never see another type (nuh nuh yea) I say na problem for the place wey I come from Zanga the place wey I come from Ghetto boy, get over, get it on Say she never get another kind of love From this From this street Konji, pon this beat Na condition, make crayfish bend Better soup, na money kill am If life show you pepper Shey you go use am do pepper soup No food for lazy man No be for who get restaurant If trust dey this life Shey water for no dey cook fish oh [Pre-Chorus] Dem been dey give me problem But my God passy dia problem Dem been no want dey sendi me But where I come from Nobody send anybody Make you dey for your government For every corner wey you dey Na men dey govern am o I be king for my area
[Hook] Na who first craze, na em be Seniormadman (Senior) (Oh nuh nuh nah) Na who first craze na em be Seniormadman o (Oh nuh nuh nah)
[Bridge] (I tell her say na) Pikin wey dey find party rice No suppose to fear dance I get am before, oga that one no be property When the men dey dance, you sef Go shaky body, you sef (You sef go dance ololo) (oh nuh nuh yeah ee yeah) BMS, Yea... sheesh...yea..okay!