Music: Eisen Hogan
You know what it is that's what it is
This a personal vibe only you know
(Aiccee)
I no wan shout for this mic abeg
I took a time out to get
Myself on the right track
But look at me na come
Be like say I dey smoke crack
And All this hustle every day
To secure nice racks
With a gold plaque
Omoh whichever go full sack
I no wan come dey
Brag cos baba get my back
You fit to call me Jill
Cos I no like to Jack
And if you talking shit
You get your ass smacked
Why she dey call me baby
I no like Cerelac
Tic Tok
Make una go check your wristwatch
Na baba God dey bless man
Nobody fit curse man
Because when your time
Reach dem go call you boss man
All this kele for your side
Omoh you too like woman
I dey pray make e better for you
I dey pray make baba God bless you
So you fit catch your cruise
Cos this life man
Make you know e no get part two
Why you come
Dey make her feel like say
She be your tattoo
(I no ask you)
The picture is now clear
Shey I tell you no follow
Tina you no go hear
Now she don come carry
All your money disappear
Oya Shift make
I kuku drink my beer
I dey catch a vibe
Everyday and that's true
Mama say give me
Your resume make I review
Shima heart strong
Be like say na bamboo
But I laughed like
If she only had a clue
(What to do)
Na so this my nigga
Wan dey come dey bone face
Omoh No dey hate
This is just God's grace
(For my Case)
Humble Being blessed
Into the United States
Surely Not perfect
Still open to all my mistakes
Living life slow Trynna
Raise the high stakes
One step at a time sha
Watch out for all the snakes
Them go come as friends
And them go come as babes
Every day I wake up
I just want dey run my race
No be full speed I just
Like maintain my lane
When you see the muscle
You call am no pain no gain
But as you dey think to make
You try to use your brain
Because if you **** up me
I go flog you with the cane
Not Abel
Met this fine shawty last night
Her name was Mabel
Put her on a personal vibe
On top of my table
Now she come dey disturb me
From January to April
(Damn from January to April)
Now she steady calling my phone
She no wan leave me alone
She say my heart dey like stone
I'm trynna shoot for my goals
Character black like charcoal
She likes to be in control
Like Lilith searching for souls
Who likes to bang on a low
But
It's not as bad as it seems
She got a low self-esteem
She Steady plotting her schemes
I'll take it to the extreme
Until I'm living my dreams
I been don stop to blow trees
Because I won learn Chinese
I had to go on my knees
That I will hustle for life
Promised to make mama smile
Because the future is bright
I no dey like to dey fight
So make I chill and drink sprite
My Guyyyy
(I say make i chill
And drink sprite my guyyy)
It's just a personal vibe for me
It's just a personal vibe for me
What you seeing is what you see
Forever chasing and living a dream